top of page

MEMBA & AWA FORUM

We born WeCiE because say we need space for internet wey dey safe an wey people fit use talk an discuss ideas dem, post question, an share knowledge, vision, an solution with odas. Dis forum dey for di voices of women wey no be white, people wey dem no dey see or hear well, wey get decades of knowledge, experience, an solution, an wey dem need a platform wey dem go use exchange, share, show, an use togeda to raise up di contribution an leadership of women wey no be white, an to make di field of Gender Based Violence in Emergencies go forward - for all of us an wit all of us. Weda you don dey dis work for decades abi you just join di field, welcome to Women of Colour for Emergencies.

Dis forum na your safe space. Oya, begin dey post. Di only rule we get be say: dey kind an tolerant.

GUIDELINES FOR FORUM

Code of Conduct

MEMBA DEM

If you work for technical field for Gender Based Violence in Emergencies

Sign up/Log In to Connect With Memba dem

View an follow oda memba, leaf comments & oda tins.

DEY KIND AN TOLERANT

Dis na your safe space. Na only one rule we get - please dey tolerant an kind. We all come from different mind for feminist dem, an places an cultures. Strong network na one wey fit hold views an disagreement wey different make e no break. Make we aim for dat.

forweb2islamic-women-friends-working-tog
forwebpregnant-women-in-class-PCWHT2J.jp

WETIN GO GET MAKE WE BLOCK YOU?

As long as we dey respectful for each oda, take di time to listen, even when we no gree; an we all work hard make we no discriminate, we no go need to block anyone from di forum.

bottom of page